On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Tinubu Don Dey Find Approval to Spend N500bn on top Fuel Subsidy Palliatives

President Bola Ahmed Tinubu don write to di National Assembly on top di amendment of di 2022 Supplementary Appropriation Act wey go allow di federal government to fit get N500 billion for palliatives to soft di effect of di petrol subsidy wey dem remove.

For one letter wey dem read on Wednesday by di Speaker of di House of Reprsentatives,Tajudeen Abbas, presido bin tok say di money go comot from di 2022 Supplementary Appropriation Act of N819.5 billion.

Di SPeaker tok say di house go thik di president request on Thursday and all di pipo wey wan contribute make dem ready come 

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C