On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

The Investment Wey Peter Obi Tok About For Anambra, No Get Level - Soludo

The Governor of Anambra state, Chukwuma Soludo don tok say the investment wey the former Governor of the state, Peter Obi they claim say eim make wen eim dey office no get level again.

Oga Soludo yarn this one when eim go one siddon tok for Channels TV wey  eim come tok about the state budget of 2023, and dem come ask am if eim plan to invest the state money just like Peter do wen eim dey office.

The Governor come tok say even though no be the reason wey eim come the interview. The investment wey dem ask am about, the value of that investment today no reach anything again.

If you remember one of the things wey the Labour Party’s presido candidate for 2023 elections, Peter Obi take dey use campaign na say the eim use the state money put for better investment wey dey bring result.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C