On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Dem Don Announce Tayo Aduloju As Di Next Chief Executive Officer

Di Nigerian Economic Summit Group (NESG) don announce di appointment of Dr. Tayo Aduloju as its next Chief Executive Officer (CEO).

A statement from di NESG tok say di group don take a large increase for under Jaiyeola wey dem apply for technology and data wey go promote di sustainable growth of Nigeria economy.

Dey kon still add say Aduloju dey com wit beta vision.

“As the incoming CEO, Dr. Tayo Aduloju brings exceptional vision and expertise to NESG,” di statement read “A distinguished scholar-practitioner, economist, policy entrepreneur, and strategist, he has contributed significantly to various reform initiatives, spanning aviation, agriculture, finance, governance, maritime, and public service sectors."

E kon still add say Aduloju’s experience dey plenty say e include am wen eim be dey  advise former Presidents Yar’Adua and Obasanjo, and e kon still join to spearhead di NESG’s national public-private leadership forums and promoting sustainable development.

Dem establish NESG for 1996 as a non-profit, non-partisan organization wey dem dedicate to advancing economic reform for Nigeria.

Dem don be di leading platform for public-private dialogue for Nigeria.

How una see dis mata???
#Chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C