On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Sudan Crisis: Nigeria Go Comot Im Citizens With 40 Buses

Di Nigerian government don tok say im go comot im citizens from di war wey dey Sudan with 40 buses for $1.2 million.

Di minister of foreign affairs,Geoffrey Onyeama, tok say on Wednesday na im Nigerians go dey comot with buses go di Egyptian border from where dem go use plane carry dem come Nigeria. 

"Di sum of $1.2 million na we spend for all di 40 buses", na so im talk.

"Becos of di risks wey dey and oda tins, di money cost. 

"We see say di French convoy bin dey attacked so e bin had small to get di buses. 

"But we need do am becos Nigerians lives mata well well". 

Meanwhile, di government tok say no Nigerian bin die for di Sudan crisis.

Di minister of state for foreign affairs, Zubairu Dada, tok say Nigeria don get 72-hour permit from Sudan to take comot im citizens batch by batch. 

Di crisis for Sudan don start since April 15 wen fight bin burst between di country Army and di Rapid Support Forces(RSF), as na former General Abdel al-Burhan dey lead di Army and General Mohamed Dagalo dey lead di RSF.

Dis two fighting don kill ova 400 pipo according to World Health Organisation(WHO).
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C