On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Subsidy Removal: Presido Don Order Review of N8,000 Cash Transfer Program

Presido Bola Tinubu don order a review of his government’s conditional cash transfer program for di transfer of N8,000 to pepo to help dem cover up di effects of fuel subsidy removal.


Dis one kon follow widespread concerns by Nigerians about how di sharing go be like and how far di money go fit help dem.


The Presido wey eim name na Bola Ahmed Tinubu don  direct di intro of di entire  package wey di government wan give Nigerians and di release of fertilizer and grains to up to 50 million farmers and pepo for all di 36 states and di FCT. 


Presidential spokesman wey eim name na Dele Alake, tok for one statement say  Presido don promise  Nigerians say di N500 billion wey di National Assembly don approve na  to cover up di pain wey di subsidy removal don cause.

He kon still tok say for dis mata dem no go be any ethnic, religious, or political wahala wen dem dey select pepo wey dem go give dis package to.


Presido don still tok say di decision wey eim administration don dey take since  na base on di e total commitment to improve  di general well-being of Nigerians.


Last week, di federal government don  propose to give 12 million pepo wey  dey receive low salary N8,000 monthly for six months and other mede-mede to help pepo cover up di wahala wey fuel subsidy don cause.


How una see dis mata??
#Chookmouth 


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C