On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Subsidy Removal: NLC Don Declare Two Days Warning Strike

Di Nigeria Labor Congress (NLC) don declare two days warning strike becos of wetin petrol subsidy removal don cause for di masses.

Di strike go start on Tuesday, september 5.

Joe Ajaero, NLC presido tok dis one on Friday for one meeting with tok tok pipo for di Labour House for Abuja wen eim dey tok on top di tins wey di join bodi national executive committee(NEC) for dia meeting on Thursday.

Di union dey tok say federal government abandon di negotiations wey dem agree upon.

Remember say NLC bin protest on August 2 against di tins we di administation of Presido Bola Tinubu dey do.

Becos of di protest, di Federal Government get seven-day ultimatum to reverse di tins wey dem dey do wey no favour di pipo like di increase of fuel price, increase in school fees, make dem pay di eight months salary wey dem owe university lecturers and workers.

Di president don tok say him economic reforms be bitter medicine wey di pipo go swallow for dis time.
 

How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C