On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Subsidy Removal: FG Don Approve N5bn as Palliative to Each State

Di Federal Government don approve di sum of N5bn for each state to take buy food stuffs and items to share for di poor for dia states.

Dis one na becos of di way di cost of food items go up as fuel subsidy comot.

Babagana Zulum, di Governor of Borno State tok dis one for Presidential Villa for Abuja on Thursday afta dem finish di meeting of di National Economic Council (NEC) wey Vice Presido be di Chairman.

Zulum still tok say Federal Government don release 5 trucks of rice each to di 36 state governors.

He still tok say di money wey government release na make di state governors dem fit buy 100,000 bags of rice , 40,000 bags of maize, and fertilizers, say 52% of di money na grant to di state governors dem and 48% na loan.

For di NEC meeting na di state governors and oda stakeholders.    


How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C