On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Stop To Dey Register Small Pikin For UTME- JAMB

The Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dey warn parents make dem no register dia pikin wey still small for UTME exam.

Prof.Ishaq Oloyede wey bi di Oga for Jamb give dis warning. Dis warning dey come afta one Mrs Ifeanyi Eke carry JAMB go court, sake of say her pikin wey bi 15 years go register for Jamb exam, den di jamb staff come dey send di pikin text message wey no good.

Prof. Oloyede tok say for pikin wey dey 15 years to don readi to go university , say mago mago dey inside di mata becos if pikin use 6 years before e enta primary school, 6 years for primary school, and 6 years for Secondary. E go don dey 18 years before e reach to enta University.

Mrs Eke don carry matter go court for Lagos. She don sue JAMB and three other people wey she no mention their names, say dem dey send unsolicited and inappropriate text messages to her 15-year-old daughter. She dey demand N100 million from dem.

Im come tok say di Board don readi to meet di woman , as dem sure wella say di person wey send di message to the pikin no dey work for Jamb.

Jamb don tok say any center wey allow make papa and mama dem , come near di place wey dem dey register pikin dem, Say na once dem go close di center.

How u see di mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C