On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Singer, MohBad, Don Die at 27

Nigerian artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba,a.k.a MohBad, don die. Him be former artiste under Marlian Records don die at di age of 27 on Tuesday.

Dis sad news bin come out from one oga for music on top him social media page. Di management of di late singer on Tuesday release official statement to confirm him death.


He tweeted, "Confirmed. MohBad is dead. Sad, sad day."

Different celebrities and musicians don react on top di mata of di death of Mohbad death. 


Nigerian rapper Olamide Adedeji, wey everybody know as Olamide,  still pos on top him social media handle,"Damn! Mohbad" for one tweet, and "This life" for another one.

"KPK," "Peace," "Komajesun," "Pariwo," follow for some of Mohbad popular songs and odas.

Afrobeats star, Davido react on top di mata too, him tweet lighted candle for di departed.


Chocolate City rapper and oga for music, MI Abaga, still carry go him social media go react on top di mata too.

Rapper and actor, Reminisce, wey e never tey e sing with Mohbad and e feature am as one of di artistes wey go dey for him upcoming project, shared one short post wey tok say, “Imole!”

As wen dis tori come out, we never know wetin cause him death and where he for die. More gist go still come out for di mata later.

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C