On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Senate Suspend Senator Abdul Ningi After Eim Tok Say Dem Add Money For Budget

Senate don suspend Senator Abdul Ningi for three months sake of say dem eim tok say dem dey add extra money on top budget.

Dem suspend the senator wey dey represent Bauchi Central Senatorial District, for the red chamber based on top say eim yarn say dem add N3.7 trillion inside di 2024 Budget.

Jimoh Ibrahim, wey be member of the Senate Appropriation Committee, na him move motion for Ningi suspension for 12 months sake of say eim dey spread fake news and dey cause wahala.

But Senator Asuquo Ekpenyong, and Senator Abdulfatai Buhari come join hand support di make dem reduce di suspension to three months.

Remember say Senator Ningi bin talk say Federal Government dey do different versions of di 2024 budget and e even talk say di N28.7 trillion budget wey President Bola Tinubu sign, say e dey favor North pass.

Even though later e come deny say e talk about different versions of di budget, e still talk say only N25 trillion of di budget dey tied to projects.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C