On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Senate Go Screen Ministerial Nominees On Monday

Di Senate don tok say e go begin di screening of di 28 ministerial nominees on Monday wey President Bola Tinubu Submit.

Tok tok pesin for senate, Sen. Adeyemi Adaramodu(APC-Ekiti), tok dis one wen eim dey tok to tori pipo afta dem don read di list of nominees for di upper chamber on Thursday.

Adaramodu tok say even though senate no suppose sit on Mondays, but because of how dis national assignment important, "dem go suspend all dia rules to start di screening on Monday".

He tok sy dem go make sure say di screening go dey very serious becos of di high expectation of di pipo wey go help Presido Tinubu to fulfill him mandate and wetin dey di constitution.

Di Senate go examine di character, personality , di experiences and di background of all di nominee. 

"Di list dey here, until dem come with dia CV, dis one no go be shadow screening becos you get good CV and you no get character to carry di CV.

On top di mata of say some of di nominees like former governors get case with EFCC, Adaramodu tok say all di nominees don go tru beta security screening from di executive, "but if any red flag show up, we go check am, Nigerians no go dey disappointed wit di 10th Senate".  


Meanwhile, di screening go start on Monday, di yearly break wey suppose start on Thursday go dey on hold  till dem finish di screening. 


How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C