On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Senate go Probe Reports Wey Tok Say Petrol Subsidy Payment Start Again for August

Di Senate go call di authorities for di petroleum sector on top reports wey tok say petrol subsidy payments don start again.

Na di senator wey dey represent Adamawa North, Elisha Abbo tok dis one.

Last week, di Daily Trust newspaper report say di federal government bin pay N169.4 billion in subsidies for August.

Dis one different from wetin President  Bola Tinubu tok when dem inaugurated am on 29 May say petrol subsidy don end.

But di Daily Trust still report say di alleged payment of subsidy for August na to keep di pump price of petrol for N620 per liter.

Senator Abbo bin tell tok tok pipo for Lagos say di Senate go investigate to find out if and why dem pay di the subsidy and when President Tinubu tok say e don end.

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C