On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Senate Go Pass Bill Wey Go Compensate #EndSARS victims

Di bill to compensate #EndSARS victims don pass second reading for senate.

Di bill name na 'A Bill for an Act to Amend the National Emergency Management Agency, NEMA Act' and na Senator Bassey Gershom sponsor dis bill. 

Na on Wednesday di Senate pass di bill for second reading. 

Senator Bassey tok say dis bill dey so e go fit provie for di #EndSARS Victims Compensation Fund. He still tok say afta all di law waka fro dis mata, dem see say plenty plenty protesters die nad pipo property still spoil. Di Senator dey tok say di victims still dey suffer di pain wey dem suffer fri di #EndSARS protest. 

Senate Presido, Ahmad Lawan send di bill go di Committee on Special Duties.

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C