On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Senate Don Confirm Di Appointments of Service Chiefs

Di Senate don confirm di appointments of di service chiefs wey President Bola Tinubu just nominate.

Di senior legistlative chamber bin confirm di nominnes afta dem screen dem for closed session on Thursday.

Di Presido bin read di letter on Monday for di floor of di Senate as him ask di red chamber to confirm di service chiefs.

Di service chiefs wey dem screen na,Maj. Gen. C.G Musa (Chief of Defence Staff), Maj. Gen. T. A Lagbaja (Chief of Army Staff), Rear Admiral E. A Ogalla (Chief of Naval Staff), AVM H.B Abubakar (Chief of Air Staff), DIG Kayode Egbetokun (Acting Inspector-General of Police), Maj. Gen. EPA Undiandeye (Chief of Defense Intelligence).

How una see di mata?
#chookmouth 


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C