On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Sanwo-Olu Don Release 39-Member Cabinet List

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don send di list of nominees for him cabinet to di State House of Assembly for screening and confirmation.

Dem send di list on Friday 59 days afta Governor Sanwoolu inauguration and e get 39 names for di list.

Di government bin release official statement wey get all di names come sen dam go Lagos State House of Assembly.

For inside di 39 names wey Governor Sanwo Olu send, some pipo wey dey di former cabinet still dey dis list like, Gbenga Omotoso, di former commissioner for information and strategy, Sam Egube, commissioner for budget and economic planning, and Akin Abayomi, di health commissioner.

Di special advisers to di governor like Aramide Adeyoye for works and infrastructure and Tokunbo Wahab for education also make di list. 

Still on still, some names from di first tenure of di governor no dey di list wey Governor Sanwo olu send to House of Assembly. Di pipo wey no dey di list from di first tenure na Rabiu Olowo, di former commissioner for finance, Moyosore Onigbanjo, di justice and attorney-general, and Yetunde Arobieke, wey dey in charge of wealth creation. 

Some of di new names dey dey di list na Lawal Pedro, Oreoluwa Finnih-Awokoya, Lekan Fatodu, and Idris Aregbe. 

Na di full list be dis:

1. Afolabi Ayantayo

2. Jamiu Alli-Balogun

3. Rotimi Ogunwuyi

4. Gbenga Oyeriinde

5. Lawal Pedo (SAN)

6. Mobolaji Ogunlende

7. Ibrahim Layode

8. Dolapo Fasawe

9. Toke Benson-Awoyinka

10. Olakunle Rotimi-Akodu

11. Abdulkabir Ogungbo

12. Abiola Olowu

13. Adekunle Olayinka

14. Bolaji Cecilia Dada

15. Aramide Adeyoye

16. Idris Aregbe

17. Yakubu Adebayo Alebiosu

18. Tokunbo Wahab

19. Bola Olumegbon

20. Oreoluwa Finnih-Awokoya

21. Kayode Bolaji Roberts

22. Moruf Akinderu Fatai

23. Seun Osiyemi

24. Barakat Bakare

25. Akin Abayomi

26. Gbenga Omotoso

27. Olalere Odusote

28. Rotimi Fashola

29. Mosopefolu George

30. Tunbosun Alake

31. Ruth Abisola Olusanya

32. Folashade Adefisayo

33. Folashade Ambrose

34. Olumide Oluyinka

35. Yomi Oluyomi

36. Sam Egube

37. Jide Babatunde

38. Olalekan Fatodu

39. Solape Hammond

How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C