On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Sachet Of Pure Water Fit Enta ₦100, Join Bodi Pure Water Producers Dey Warn

The Association of Table Water Producers don come out come shout say the way price of the things wey dem dey use take produce pure take dey go up. The price of the product fit enta ₦100 per sachet.

The join bodi yarn say the way dia production cost don climb go up don dey disturb all of dem wey dey the business.

Dem also tok say nylon wey dem buy ₦1,100 per kilogram for December 2023, don enta  N3,600 to ₦3,700 per kilogram. And with the way this price take dey waka e don make things hard for them wey be pure water producers.

The Presido of the join bodi wey be Mrs. Clementina Ativie, tell tori pipu say price of the nylon wey dem dey use fit add up ₦550,000 like 3 times inside one week.

She also tok say no be today di way things for the kontri don they give dis dia business problem. "Abi una remember say wen diesel price enta N220 per litre, we come dey sell pure water for ₦10. Today diesel price don enta ₦1700 per litre."

Wen dem look everi-everi come waka go banks, she tok say plenti bank no dey like give dem loan because of the way the business take be.

Ativie come dey tell all Nigerians say no be because dem wan suffer Naija pipu, but na the way things for the kontri don be, na eim make the price of dia market dey climb go up. Even sef many of dem enta igbese for the business.

Dis na why di join bodi come dey beg Naija pipu, say make dem no vex for dem.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C