On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Residents Don Tok Say Dem Must Carry Out Investigation About Di Building Wey Collapse For Port Harcourt

Some pepo wey dey stay for Port Harcourt don com out say make dem investige wetin make di building collapse.

Reacting to di storey building wey collapse for off Okilton Drive in Ada George Road axis on Thursday wey be di 29th of June and dey wan make di Standard Organization of Nigeria (SON) tok for dis mata and make dem also look inside di production and how dem de sell building materials.

 
One of the eye witness kon tok say na Fake materials dey everywhere say  make di organization dey monitor di during and after production. E kon tok say di 4.5mm rod wey dem know b4 nor be di same again and make di organization (SON) make dem make sure dem produce original materials.

Anoda pesin kon still tok say di engineers and di pepo wey own building lack patience, say when dem dey undertake a project say dem wan build a house in less than four month bypassing d normal process.

E kon still chook mouth say dis pepo dey manage cement and building materials and dem nor dey consider di strength of di land before dem build anything and na wetin dey cause di collapse everytime.


Four pepo wey bin sustain injuries don dey receive treatment and di Secretary to di State Government wey eim name na Tammy Danagogo don say make dem arrest di engineer wey bin construct di building.


E kon still chook say dem don setup investigative panel wey go look into di mata and e kon warn all professionals wey dey di building sector say make dem follow all di ogbonge rules wey dem setup.

How una see dis mata???
#Chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C