On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Reps Don Reject Di Motion Wey Tok Say Make Dem Stop To Increase Petrol Price

Di House of Representatives don reject di motion wey tok say make dem stop di rise in di prices of petrol and say make dem return am back to di old petrol prices wey be N488 to N537 per liter.

For di motion for di urgent public interest by Rep. Ikenga Ugochinyere for di assembly meeting wey dem hold on Wednesday, di House don tok say make dem get to di bottom of di immediate rise for di price of petrol and di way e dey affect transportation for Nigeria.

Di lower legislative chamber don tell di  Group Managing Director of the Nigeria National Petroleum Company Limited wey e name na Mele Kyari and other oil sellers  say make dem com before di jury pepo dem and tok why di price rise recently.

Di committee get di duty to find ways to make sure say dey give out di goodies wey dem wan give pepo to use ease di tension wey di removal of fuel subsidy don cause.

How Una take see dis mata??
#Chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C