On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Presido Tinubu Enta Naija After Him Go Di G20 Summit For Germany.

Presido Bola Tinubu don come back Abuja after him go di G20 Compact with Africa (CwA) Conference for Berlin, Germany.

Di Presido enta Abuja on Wednesday night afta five days wey him comot.

As e arrive, Na di Minister of di Federal Capital  Territory(FCT), Nyesom Wike; di National Chairmo of di All Progressives Congress (APC), Abdullahi Ganduje; and him Chief of Staff, Femi Gbajabiamila; for  Nnamdi Azikwe International Airport, Abuja.

During his stay in Wen he stay for Germany, Presido Tinubu with oda Heads of State and Government, and oda big big oga for international mata to fit see how ecomonic and business cooperation go dey.

Afta dat one , he still follow for di Fourth G20 Investment Summit, wey German government and business associations follow host.

To make our relationship with oda kontris beta, Presido follow German Chancellor, Olaf Scholz and oda big ogas dem on Monday.

How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C