On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Presidential Tribunal Mata Pause Becos of INEC’s Witness

Di planned defence of INEC before di Presidential Election Petition Court bin pause on Monday morning.

Dis one na becos INEC's witness no show.

INEC wey be di first respondent for di petition by Peter Obi and di Labour Party suppose open defence today.

Wen dem mention di case around 9:30 am, di lawyer to INEC, Abubakar Mahmod tell di court say even though him clients plan to call three witnesses for three days, say di one wey suppose happen today no go fit come becos of some family issues.

Mahmoud come apply for adjournment till Tuesday so di witness go fit come court.

Di oda parties lawyers no object to di request by Mahmoud.

Di Presiding Justice , Justice Haruna Tsammani come adjourn di hearing of di case to Tuesday, 9am.

Di court don rise but with promise say dem go come back by 2pm for di petition by Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party.  
  

How una see di mata?
#chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C