On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

President Tinubu Don Be Di New ECOWAS Chairman

President Bola Tinubu don be di new chairman of the Economic Community of West African States (ECOWAS) for di 63rd Session of di Authority of Heads of State and Government for Bissau, Guinea-Bissau.

Dis one show say oda Presidents of oda countries trust President Bola Tinubu.

President Tinubu collect dis one on behalf of him country. He pledge say him go do di work well well and still carry everyone along wey dey di organization.

Tinubu Work for ECOWAS:

President Tinubu tok about di need to deal with insecurity, terrorism and militry wahala for di sub-region.

Tinubu don call all di states wey be member say make dem bring all dia plans to match di goals for ECOWAS.

Tinubu tok say e dey important well well make all di countries wey di dis join bodi come together make peace and security dey.

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C