On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

President Buhari Don Arrange Emergency Security Meeting.

Presido Muhammadu Buhari go do meeting today Monday wit di security chief dem for Abuja to carry see how security mata fit strong for inside Naija.

According to di informate wey di Senior Special Assistant ontop Media and Publicity mata for Mr President,Garba Shehu tok say President Buhari go hear from di security pipo dem and dem go put bodi for area wey need serious attention.

Di emergency meeting dey happen one week after di United State Embassy inside Naija bin give warning about di risk of terror attack inside Abuja. 

Dis meeting go make President Buhari postpone di plan to open di new technology and innovation hub.

 

How U See Di Mata? #chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C