On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Port-Harcourt-Maiduguri Rail Line go Start to Work This Year

Train services go start for di Port Harcourt-Maiduguri rail line this year, na so di Civil Engineering Construction Corporation (CCECC) tok.

Abraham Joseph, di manager of di construction company wey dey handle di reconstruction of di rail line tell  Nigeria Info on Thursday say dem get December 20 as deadline.

Dis one wey him tok go make di mind of di pipo wey wan travel from di South-southern and Southeastern parts of Nigeria go North come down. 

Dis one na stil consolation to di pipo wey dey live for Port Harcourt wey di work affect as dem block di major road for Woji Area. 

pipo wey dey pass di road tok say nobody tell dem about di work sey dey happen for dirail track.Commuters and motorists said they were not informed about the work on the rail track.

Dem bin suspend di work for di Port Harcourt-Maiduguri Eastern rail line for September 2022 by di former minister of transportation, Muazu Sambo, becos of insecurity and bad guys movement wey dey happen for di track. 

How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C