On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Police Don Arrest Some Yoruba Nation Pipo

Lagos State Police don Arrest 2 Yoruba Nation pipo wey dey cause wahala and Oyo State Police arrest 5.

Nigeria Police Lagos state Police Command don come out tok say dem don arrest two members of Yoruba Nation.

Police tok tok person, Benjamin Hundeyin tok sy di pipo wey dem arrest bin go scatter tins for one Police station for Alausa, Lagos state early Sunday morning. Di Yoruba Nation pipo wey land di police station reach 15 but dey shout say "Yoruba Nation don take over", still dey wound police as dem dey try pursue dem comot. na only 2 police fit hold as di rest run comot. 

As dis one dey happen, anoda set of Yoruba Nation pipo go burst enta one Radio Nigeria FM for Ibadan, Oyo state.

Around 6am for Ibadan, dem attack di station, enter the live studio dey declare Yoruba Nation. None of di staff dey injured as dem run as di Yoruba Nation pipo reach there.

Di Police for Oyo arrest 5 of di Yoruba Nation pipo as di Commissioner of Police for Oyo state tok say dem go make sur say dem go protect lives and properties. 

Di suspects for Lagos carry charms dangerous weapons and symbols of di Yoruba Nation Army and for Oyo, di suspects carry charms.

Meanwhile, di Yoruba Nation activist join bodi don come out tok say dia hand no dey fro dis badness wey happen. Di oga of di join bodi, Prof. Banji Akintoye tok say na criminals weydi pipo wey do dis badness and di join bodi no go rub bodi with dem. 

How una see di mata?
#chookmouth  

   


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C