On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Police Don Arrest Six Pipo Ontop DPO Killing

Dem don arrest six suspects for di killing of di Divisional Police Officer (DPO) of Ahoada in Rivers State.

Bad guys corner SP Bako Angbashim and kill am on Friday after he bin dey lead team of police officers to go raid di hideouts of some bad guys for Odumude, wey be one community for Ahoada East Local Government Area for Rivers state.

The Rivers State Commissioner of Police, CP Emeka Nwonyi, tok say dem collect local pistols and charms from di bad guys.

He still add, for one statement, say di suspects dey interrogation for di State CID, Port Harcourt.

Meanwhile, di  division don get new DPO, SP Zuokumor Richard. Him go get half a unit of men from Mopol 48, and a one-third unit from Mopols 19, 56, and correct teams.

Di police statement tok say di new DPO don get work to search di crime area well well, to arrest di bad guys, to collect di officer bodi and where dem for use di weapon.  

Dis one go happen as dem dey probe di suspects wey dem don arrest. 


On Saturday, N100 million bounty don dey on top di head of Gift Okpolowu a.k.a 2-baba, and him gang for di killing of di late DPO.

Di Rivers State government announce di bounty for one statement wey di Governor Siminalayi Fubara sign.

Di government still announce say di  indefinite suspension of di Eze Igbu Akoh II of Akoh Kingdom, Eze Cassidy Ikegbidi,becos him comot bodi for him territory so Gift and him gang to fit operate.

He still follow do pele for di family of SP Bako’s family and di police command for di loss.

How una see di mata?
#chookmouth
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C