On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Police Don arrest One Woman Becos She Allegedly Cut Off Her Husband’s Manhood

One Katsina woman go show for court on top say she allegedly cut her husband manhood

One Tinene Isa don dey tell di police command of Kastina State everitin wey she know on top di mata wey she allegedly cut her husband manhood comot. 

Di Police Public Relations Officer, ASP Abubakar Aliyu confirm for one interview with di News Agency of Nigeria(NAN) say dem don arrest di woman on Wednesday.

Aliyu no tok di name of di victim but e tok say eim dey critical condition for General Hospistal for Malumfashi.

Oga Aliyu tok say dis mata shele for Kafur Local Government Area. 

He still add to di mata say di suspect bin use razor blade take do di badness.

Investigation still dey go on for di mata.


How una see di mata?
#chookmouth 
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C