On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Oyo Explosion: Illegal Miners Dey Responsible, Two Pipo Don Kpai- Seyi Makinde

Governor Seyi Makinde don tok say two people don kpai for di explosion wey shele for Ibadan on Tuesday night, and 77 oda injure.

Governor Makinde waka go di place wey di explosion shele. He tok say di pipo wey injure don already waka go different private and public hospitals for di city make dem fit treat dem. E tok say government go carry di bills for dia treatment and dem go arrange place for people wey dia house spoil because of di explosion.

Governor Makinde tok say di explosion happen because some people wey no get license to mine, dey mine and dem keep explosive things for one house for Bodija. E tok say security pipo dey find di pipo wey do dis badness and anybody wey dem catch say e dey involved, go follow waka go court.

How u see di mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C