On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Ondo Gov Akeredolu Don Give Power To Eim Deputy As Eim Dey Go Medical Leave

Governor Oluwarotimi Akeredolu of Ondo State dey prepare to waka enta medical leave, and e go transfer eim power give eim deputy, Lucky Aiyedatiwa.

Richard Olatunde, wey be tok-tok persin for di governor talk dis one for statement wey e release on Tuesday, to confam say di governor go start eim leave from Wednesday.

Akeredolu, wey dey 67 years old, enta office for eim second term for February 2021 afta eim win re-election for October 2020. But since dat time, e don dey yan heavy talk from opposition pipo sake of eim continuous absence from office, based on medical reasons.

Olatunde talk for eim letter say, "Dem go send formal letter about di medical leave and notice wey go formally transfer power according to Nigerian Constitution to di House of Assembly.

"As Senior Advocate of Nigeria and pesin wey pipo respect well-well for Naija, Governor Akeredolu don dey always give eim deputy power anytime e waka for eim annual vacations. Dem don observe dis practice for April 1, 2021, April 1, 2022, April 3, 2023, and July 10, 2023, wen e waka enta vacation before", e add.

Make we remember say Akeredolu bin just waka return from abroad recently afta many months wey e spend there for treatment.

As pipo still dey yan say make di governor, based on di 1999 constitution, resign and give eim power to eim deputy, Aiyedatiwa, di House of Assembly dey split on top di mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C