On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Oil Sellers Don Come Out Tok Say Dem Go Add Money For Petrol Price To N720/Liter

Oil sellers for obodo naija don warn say di fuel price fit add money anytime soon, and e go dey between N680 and N720 per liter.

Dis na becuase say di way naira don dey weak against dollars, on top di foreign exchange scarcity mata.

Dis fuel bin don dey sell for about N910 and N950 for black market for some days now.


Pipo wey dey deal wit dis petroleum products nor fit import wetin dem bin oda because of dis wahala wey dey.

Di Central Bank of Nigeria's Importers and Exporters (I & E) foreign exchange window don fit lower di exchange rate small small dan wetin dey di black market, but oil industry pepo dem tok say di market sef nor fit produce di  $25 million to $30 million wey suppose dey for di daily petrol importation. 


Dem don dey tok say di way petrol go add money nor be sumtin we go fit escape if naira rate nor add.

Leaders of key oil industry associations, join di Major Oil Marketers Association of Nigeria, di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, and di Petroleum Products Retail Outlets Owners Association of Nigeria, don com out tok say make federal government sef chook mouth for di mata.


How una see dis mata?
#Chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C