On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

October 1: Federal Government Dey Plan Low-Key Independence Celebration

Di federal government tok say Nigeria 63rd independence celebration go dey low-key to show how di mood be for di kontri.

Di Secretary to di Government of di Federation, George Akume,tok dis one on Monday for Abuja wen him dey tok to tori people on top October 1 mata.

Most Nigerians still dey struggle with di economic wahala becos of di removal of fuel subsidy and e no go make sense if dem do big celebration, na so him talk.

He still add say di government dey focus on to comot di sufferings of Nigerians and to bring socio-economic develop to all di parts of di country.

Some of di events wey dem organize to mark dis year anniversary na public lecture, religious services, and military parade for di Presidential Villa.


How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C