On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Obi Don Also Ask Di Supreme Court To Comot Di PEPT Judgement

Di Presidential candidate of Labour Party Peter Obi don file 51 grounds of appeal for supreme court to comot di judgement of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) wey declare Bola Tinubu winner of presidential election.

For di appeal wey Obi file on Tuesday he tok say di verdict dey wrong.

Him lead counsel,Dr.Livy Uzoukwu (SAN)argue say di tribunal justices dey wrong as dem no tok   di polling units for where di cheating hapen.
Peter Obi and Lp tok say dem prove di over voting for 13 states.
dem tok say di tribunal no follow di law and di prove of di reports wey dem tender.
Obi team tok say di justices no rule say na di duty of INEC fail to agree wit di requirements of section 73(2) of di Eletoral Act for conduct of di 2023 preidential election.
him counsel tok say INEC no agree to produce di election material Obi team apply for di PEPT writ for di election umpire.
Obi file dis petition same day wey Atiku file eim own. 
                                                                                                                                                                                                          


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C