On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

NRC Don Stop Service For Now As Train Spoil For Kogi State

Train wey carry 148 pipo don spoil for forest wey dey for Kogi State come abandon dem.

Di train bin dey travel along Warri-Itakpe rail lne on Sunday when di yawa come happen.

The Nigeria Railway Corporation tok say nobody die and dem don commot all di pipo wey bin dey inside di train outside safely.

But still, dem don stop operation for di rail line.

Dem never tok wetin cause dis accident wey happen just a month after dem kidnap nothing less than 20 passengers from train station wey dey Igueben, Edo state.

Di same train wey dey operate for Warri-Itakpe road na im dey say spoil.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C