On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

NPC Don Announce Three-Day Nationwide Movement Restriction for Population Census

Nigerians go ready to see three-day movement restriction for di whole country as the National Housing and Population Census go soon start.

Na di Chairman of di National Population Commission, Hon.Nasir Isa Kwarra, for one meeting wey him get with di Dimplomatic Corps for Abuja on Thursday. 

Di census fit start on Wednesday, May 3 , 2023 and end on Sunday, May 7, 2023. Dem fit change dis date later afta dem do do sidon discuss with state governors. 

Hon. Kwarra still tok say di commission go work with di Minister of Foreign Affairs to see how di pipo wey dey work for Nigerian government and dey live for oda countries go fit join for di census. 

On top dis one, di Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama still tok say dis census important well well for di develop for Nigeria.  


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C