On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

NNPC Don Increase Price Of Fuel Inside Obodo Naija

The Nigerian National Petroleum Company Limited don agree to the new pump price for petrol. The price of fuel don increase from N165 per liter to N169 and N184 according to different state for inside Nigeria where dem dey sell fuel.

And this one na the first time wey e go happen for inside different state wey dey for inside obodo Nigeria.

For inside Lagos, petrol stations don begin dey sell am for the price of 169 per liter plus including  Abuja wey dey sell am for the price of N174.

For inside south west, south-South, and North central states, dem go sell petrol for 184 while for inside South East and North West states, dem wan sell for the price of N184.

Dem even yarn say, for inside North West, na for that side e go high pass as dem wan sell am for the price of 184 and this one go make go transportation increase for inside Lagos sake of say na from Lagos dem dey send petrol go other parts of the contri.

NNPC been wan sell am for their former price of 148.17 but dem con reason to sell am between  the price of N160 to N162 per liter but for inside Warri, Ogharra depot na between 162-165 and for inside Port Harcourt, a between the price of N165 to N167.

Na the former price wey petrol depots been dey sell, na I'm petroleum products marketers dey pay for fuel now for inside depot before dem carry their storage tanks of filling stations.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C