On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Nnamdi Kanu: Supreme Court Don Sets December 15 As Day Of Judgement

Supreme Court don set December 15 as di date wen dem go deliver dia judgement on top di appeal wey dem wan make dem release Nnamdi Kanu, di leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), wey dem dey hold for detention.

Justice Kudirat Kekere-Ekun wey dey lead five-member panel, don set di date afta di lawyers wey dey represent di Federal Government and Nnamdi Kanu present dia final arguments.

Kanu's legal team, wey Kanu Agabi dey lead, bin appeal to di court say make dem no just release dia client, but make dem also put heavy fines on top di Federal Government.

Counsel to the Federal Government, Tijani Gazzali, bin beg di Supreme Court make dem support di argument wey dem don amend for May 3, 2023.

E beg di court make dem support di government's appeal, comot di Court of Appeal judgement wey order say make dem release Kanu, and begin im trial again for di Federal High Court for Abuja on top di terrorism charges wey dem accuse am of.

Remember say on October 13, 2022, di Court of Appeal for Abuja bin rule say make dem release Kanu and cancel di 15-count terrorism charges wey Federal Government bin accuse am of.

Di Court of Appeal talk say government break di law as dem carry Kanu from Kenya come Nigeria by force for trial.

But Federal Government no happy with dat ruling, dem carry di mata reach Supreme Court and dem succeed to make dem stop di judgement until dem resolve di government's appeal.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 26°C