On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

NLC Don Suspend Di Strike Afta Presido and Senate Chook Mouth

Di National Labour Congress (NLC) don suspend dia planned strike afta Presido Bola Tinubu chook mouth come get emergency meeting with di Senate.

Dem bin decide dis one for one National Executive Council meeting wey di Congress get late on Wednesday.

Di NLC bin don get nationwide protest on Wednesday wey demm dey sk for better life for Nigerians for di kontri.

President Tinubu come later discuss with di labour leaders for state house for Abuja.

Di NLC presido, Joe Ajaero later announce say him go carry wetin dem discuss go meet  him collegues for di labour movement.

Ajaero still tok say di presido make some promises as aaper wetin dem dey ask for.

During di protest for Abuja on Wednesday, protesters wey dey vex comot di gates of National Assembly so dem go fit meet di lawmakers dem.

How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C