On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

NLC Dey Threaten To Go Strike If Petrol Price Increase

Nigeria Labour Congress (NLC) don dey threaten again to go indefinite nationwide shutdown of di country, if another increase dey Petrol Pump price from di 617 naira wey e dey

NLC Presido , Joe Ajaero tok dis one on Monday for di African Trade Union alliance meeting for Abuja.

For di meeting, Ajaero tok say di increase wey dem wan increase say na illegal sometin. Dem still warn say make Government no push wetin dme dey ask for go corner.

Oil marketers on Sunday don tok say di price of petrol go go up between N680 per litre and N720 per litre if dollar still dye go up from N910 to N950 for di parallel market.


How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C