On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

NLC and TUC Don Blame FG And Dem Nor Gree Make Arrangement On Top Di Petrol Hike Mata

Di Nigeria Labour Congress and di Trade Union Congress don com out tok say dem nor dey happy wit di way Presido dey add money to di petrol price

For di statement wey di National Presido of NLC tok, Joe Ajaero, di NLC don condemn di Tinubu government say dem dey take from di poor to take pay di rich,say dem don add suffering,hardship and sorrow for pepo bodi as dem increase di fuel price.

“The proposal to pay N8,000 to each of the so-called 12 million poorest Nigerian households for a period of six months insults our collective intelligence and makes a mockery of our patience and abiding faith in social dialogue which the government may have alluded to albeit pretentiously,” Mr. Ajaero stated.

“Further proposal to pay National Assembly members the sum of N70 billion and the Judiciary N36 billion is the most insensitive, reckless, and brazen diversion of our collective patrimony into the pockets of public officers whose sworn responsibility it is to protect our nation’s treasury,”He added.

Di Trade Union Congress don dey blame di federal government for di increase for di price of petrol.

Di TUC’s National Vice President wey eim name na Tommy Etim kon still tok say di country dey go towards economic chaos.


“We are entering one chance. It is unfortunate that the government is insensitive to the plight of the commoners and the poorest of the poor.  You can see that fuel, which is essential to the movement of goods and services, including informal businesses, has continued to fluctuate in price,” he said.

Dis mata com out becuase say di fuel price don rise, say some fuel station dey sell for about N600 to N700 for various locations for obodo Nigeria. 

Di NNPC and di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority tok say na di market force wey cause di rise for di price of petrol.

How una see dis mata??
#Chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C