On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Nigeria Custom Don Start To Sell Rice Wey Dem Seize

As part of dia waka to stop food scarcity wey dey sama pipu inside Nigeria wey, di Nigeria Customs Service (NCS) under di leadership of Comptroller-General Bashir Adewale Adeniyi MFR don show face with better plan.

Dis plan, wey dey follow for di vision of President Bola Tinubu's government, dey aim to helep solve di wahala of no food for di kontri. As dem start dis program with di sharing of rice wey dem seize for Lagos, CGC Adeniyi make clear say e important mago-mago no dey as dem dey share di food and make sure say di people wey need am pass dey collect am.

this waka na to make sure say di food wey dem dey share enter di hand of those wey need am well well. Adeniyi still tok say dem go target areas wey customs dey active well, and pipu for the communities dey feel di hardship. 

Plus, NCS don get approval from the government to sell di seized food items for better price to those wey need am, and dem tok say make dem use NIN to verify people well, so di thing go transparent.

Pipu go fit to buy 25kg rice for just ₦10,000 only.

Adeniyi make am clear say di food no be for resale, say make people make nobody use this one come dey do business and make pipu  report anybody wey dey re-sell am.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C