On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Nigeria Don Reopen Land And Air borders With Niger.

Presido Bola Tinubu don give order say make dem open Nigeria land and air borders wey dey with Niger, afta e don close dem for seven months.

 President don order say make dem lift oda sanctions against di kontri with immediate effect.

Di sanctions include di suspension of commercial and financial transactions between Nigeria and Niger, di freezing of utility services and electricity supply to Niger, di freezing of assets wey Niger get for West African central and commercial banks, and travel bans wey dey on top Nigerien government officials and their families.

For one presidential directive wey dem sign on Wednesday, wey spokesman, Ajuri Ngelale, tok about, Presido Tinubu say im new directives dey follow wetin ECOWAS Authority of Heads of State and Government bin decide for dia extraordinary summit for Abuja on 24 February.

For di meeting, di Economic Community of West African States agree say make dem lift economic sanctions against Niger, Mali, Burkina Faso, and Guinea.

Dem bin close Nigeria-Niger borders afta di military coup for Niger.

Presidential guards take over power for 26 July 2023, wey dem arrest President Mohamed Bazoum, and allow General Abdourahamane Tchiani, wey be di commander of di Presidential Guard, to become di kontri leader.

Ngelale also tok say Presido Tinubu don approve make dem lift financial and economic sanctions against di Republic of Guinea.

 

Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C