On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

News Director Wey Dem Kidnap Don Dey Free

Di police don confirm say di female tok tok pesin ,Priestba Wokocha wey dem kidnapp don free.

Na di tok tok pesin of Rivers State Police Command, Grace Iringe Koko tell Nigeria Info dis one.

Her family tok say dem free Mrs. Wokocha early Thursday morning.

Gunmen bin kidnap dis woman wey be di director of news for Rivers State Broadcating Corporation wen she dey come back from work around Golf Estate Highway, Trans Amadi, Port Harcourt on Thursday, last week.

Di bad guys wey hold am bon ask for N150 million ransom but later come reduce am to N10 million afta plenti calls to free her.

We no come know weda dem pay any ransom.

How una see di mata?
#chookmouth 


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C