On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

New Naira: Court Don Set March 3 For Judgement

The Supreme court don push the mata of the new Naira note go March 3, 2023.

This one mean say, Naija pipu wey dey wait for the oga kpata pata court to tok ontop the mata. Becos of the hardship wey dey ground go need to wait.

The court been don tok on February 8 say make Federal Government gba break for dia February 10 deadline ontop changing of old money to the new Naira note.

But as e be Central Bank of Nigeria no gree do as the court tok.

Zamfara, Kogi and Kaduna state governments  na some of the states wey carry the mata go Supreme court, and other states like Lagos, Ondo, Ekiti, Kano, Sokoto, Ogun and Cross River. Don join bodi inside the case.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C