On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

New Monetary Policy Go Fix Naira And Go Slow Down Tok -Shonubi

President Bola Tinubu don direct di Central Bank of Nigeria (CBN) say make dem apply strict monetary policies wey go fit balance naira and add ginger to di nation's economy.

Di acting Central Bank governor, Folashodun Shonubi, come out tok dis one  on Monday afta he don receive informate from presido.

Shonubi, wey no really open mouth tok di specific measures wey CBN go take, E  tok say currency pipo go lose big  money wen di measures dey in place.

Di acting CBN governor kon still add say supply go go up for days wey dey come wey go help wit di  foreign exchange market.

"Mr. President is very very concerned about some of the goings on in the foreign exchange market. We have discussed and shared with him what we're doing to improve supply. If you look at the official market, you will find that that market has been fairly stable and the spreads of the difference have not fluctuated as much,” Na so e open mouth tok.

“We do not believe that the changes going on in the parallel market are driven by pure economic demand and supply but are topped by speculative demand from people.

“Some of the plans and strategies which I'm not at liberty to share with you, mean sooner rather than later, the speculators should be careful because we believe the things we're doing when they come to fruition may result in significant losses to them.

Hot Tori go still drop about di new policy, and na CBN go open mouth tok for dis one.


How una see dis mata?
#Chookmouth


 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C