On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

NAPTIP Don Expose Di Women Wey Dey Rent Small Children To Dey Beg For Nyanya

Di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) tok say dem don stop women wey dey give babies out to dey beg for Nyanya for Federal Capital Territory.

NAPTIP tok say di women dey rent out di babies for N3,000 for 1day and dem dey responsible for di high rate of child beggars for FCT and oda parts of Nigeria.

Di Director General of NAPTIP, Fatima Waziri-Azi  tok dis mata for one press briefing on Tuesday wey dem do to celebrate di 20th anniversary of NAPTIP and di 2023 World Day Against Human Trafficking.

She warn women wey dey do dis badness make dem stop am, she tok say over 1.6 million Nigerians dey live for dis modern-day slavery.

Permanent Secretary Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Nasir Gwarzo, give NAPTIP beta handshake for work wey dem don do for over 20 years.

He tok say NAPTIP don report 14,813 reported cases of human trafficking, 10,000 arrests, 623 judgements, and dem don deport one ogbonge human trafficker to Italy make eim go jail.


How una see dis mata? #Chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C