On Air Now

Satide Jolli

6:00am - 10:00am

Naija People Dey Cry As House Rent Don Increase

House na one of the Koko thing wey person need for this life but for plenti Naija people e don dey hard dem to fit continu to keep the house wey dem and dia family inside.

Nairalytics wey be company wey dey chook eye for mata wey concern economy, don come out come tok say money for house rent don increase up to 100% for inside places like Lagos, Abuja, and Port Harcourt. 


Dem tok say the cost to rent self-contain for Kubwa area for Abuja now na N500,000 and e be N150,000 three years before. And dem dey rent two-bedroom flat N900,000 and N1.5million per year and na N600,000 before.

Na the same thing for Port Harcourt too, because cost of rent don increase pass 100% for last three years for that place too.

One house agent for Lagos, Segun Oni wey also be real estate developer. yarn say the reason wey make the rent dey run go up na because building materials don cost. And na since after COVID lockdown naim dis one start. 

Our tori persin wey go Lagos street to see wetin many pipu dey pay for rent. See say places like Ajegunle, Mile 2, and Ojo area. The rent don add up to 100%. For example Ajegunle new building wey get room and parlour self contain dey rent for N600,000 and the property owners tell the tenants wey dey come to pay for two years, making 1.2 million naira.


The big question now na how Naija people go fit get money take dey pay this kind rent. As even Nigeria Bureau Of Statistics (NBS) don yarn say 133 million Naija pipu dey poor for 2022, and that one na like  65% of our populations.

Naim make many Naija pipu now don dey look for work wey dey online so that dem go fit live for place wey no cost dey do the work ontop internet. 

But how pipu wey no go fit work online go take survive? Only time go fit tell.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 28°C