Nigerian Air Force (NAF) don talk say their C-130 plane wey land for Bobo‑Dioulasso, Burkina Faso, no be because dem break airspace — na precautionary landing after dem notice technical problem mid-flight.
NAF spokesman Ehimen Ejodame explain say the aircraft dey on ferry mission to Portugal when the fault show, and because dem see danger, dem divert go the nearest safe airfield for Bobo-Dioulasso to avoid risk.
All 11 people wey de inside — crew plus other military staff — dey safe, and Burkinabe authorities welcome them well.
NAF also assure say once dem fix the technical issue, the mission go continue, and that dem still dey uphold strict safety and operational standard.
Bifor bifor, Burkina Faso tok say dem hold the plane after im cross enter their airspace.