On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Na Three Pipo Dem Rescue as Container Crush Car for Lagos

Lagos State officials don rescue three pipo after one 40ft container fall on top one Toyota Corolla car wey dey go Ojuelegba on Sunday night.

Di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) report say di container-laden truck bin dey climb di bridge wene loss eim balance come turn over land on top di car.

From di statement na two adult men and one woman dey trapped for inside di car. 

Di statement tok say, "Operatives of di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA), Police and other emergency responders last night rescue 3 casualties from saloon car wey dey trapped for Ojuelegba go inside Stadium for Funsho Williams Avenue, Surulere, Lagos.

“Traffic Officer Olajide Olukoga 'Bravo' wey lead di Lastma rescue operations for di scene of di accident confirm say one 40ft container fall on top of one Toyota Corolla car (JJJ 811 FB) for di the  Ojuelegba bridge inwards Stadium.

“He still confirm say out of di 3 pipo wey dem rescue from di Toyota Corolla saloon car, only one (male) come out wey nothing do am and him comot for there immediately.

“Di remaining 2 pipo wey dem rescue (an adult male and a female), dem carry dem go hospital sharp sharp with one ambulance wey LASEMA get.

“Police men from Surulere Police Division dey there to make sure say security dey. While di full Ojuelegba bridge inside Stadium, dem close am first as dem divert traffic go di service lane by Lastma as Rescue and recovery operations dey ongoing.”


How una see di mata?
#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C