On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Na March Go Decide If Nigeria Go Play 2027 AFCON!

Super Eagles Don Enter Corner! Na March Go Decide If Nigeria Go Play 2027 AFCON!

Nigeria football pride dey face another serious test, as Super Eagles 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) qualification hope dey hang for balance ahead of two very important matches wey dem go play for March.

Di three-time African champions don put themselves for tight corner after dem fall behind Guinea-Bissau for Group L.

Nigeria don get seven points already, while Guinea-Bissau dey lead di group with 10 points. Dis one mean say Super Eagles must win dia remaining two matches against Madagascar and Guinea-Bissau if dem wan keep dia AFCON dream alive.

Nigeria go first travel go face Madagascar on March 24 before dem return home to host Guinea-Bissau on March 28.

On paper, dis na two matches wey Nigeria suppose get enough quality to win. But with di kind performance wey di team don put up so far, nobody fit guarantee anything again.
Another thing wey fit determine Nigeria qualification fate na Guinea-Bissau next match against Tanzania.

If Guinea-Bissau lose or play draw against Tanzania, Nigeria fit overtake dem for the group table by winning dia two remaining matches.
But if Guinea-Bissau beat Tanzania, both teams fit end di campaign with 13 points each. If dat one happen, head-to-head record go become very important mata.

And na here di matter fit get more complicated.
Guinea-Bissau don already beat Nigeria 3-0 for dia first meeting. So, Super Eagles need a big win for the return leg to cancel out dat advantage, depending on di tie-break rules wey dem go use.

Di calculation deh clear, but Nigeria no get room to make another mistake.

Super Eagles must win dia remaining matches, and possibly win dem with good goal margins, while dem dey hope say results from other matches go favour dem.
For a country like Nigeria, wey get rich football history, resources and plenty talented players, di possibility of missing AFCON no be small matter.

E dey raise serious questions about di direction of Nigerian football, di consistency of the national team and di way our football authorities dey manage di game.

Di big question now be: weda Super Eagles go rise to di occasion, fight back and save dia AFCON dream, or we dey about to witness another painful chapter for di decline of Nigerian football?

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 26°C