On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Dr. Ngige Blame Economy For High Unemployment Inside Naija

The Minister of Labour and Employment, Dr. Chris Ngige, don yarn say him and other ministers dey collect N942,000 afta dem pay dia tax and the only allawee wey dem dey collect na when dem travel go do work.

Dr. Ngige tok this one wen eim siddon tok with Channels television's politics Today.

Eim also say even special advisers dey collect almost the same salary.

When dem ask minister oga Ngige about how the Buhari administration don fail so stop the wahala of unemployment for inside the country wey don enta 33.3 per ent for 2021, Dr. Ngige tok say the work to end unemployment no only dey for the hand of the government but also for the hand of the private sector.

Eim still say na because plenti oyibo pipu no dey carry money come Naija to come create work, and wetin go make this oyibo pipu carry money come na id the economy strong wella, Ngige come to tell pipu wey dey private sector to chook eye and put dia money for inside industries and agriculture sector.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C