On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Mohbad: Naira Marley Dey Our Hand- Police

Police for Lagos don confam say Afrobeat musician Azeez Fashola wey pipo sabi as Naira Marley dey dia custody because e get link to di death of Ilerioluwa Aloba, wey people sabi as MohBad.

Di spokesperson for di command, SP Benjamin Hundeyin, yan dis tori for im Twitter handle wey im name na @BenHundeyin for Tuesday night.

E talk say Naira Marley dey help dem with di ongoing investigation wey concern di matter wey lead to di death of di 27-year-old singer.

Hundeyin talk say, "Dem don carry Naira Marley go custody make e answer questions and also make e helep dem for di investigation wey dey go on."

NAN (News Agency of Nigeria) report say Mohbad die on September 12 and dem bury am on September 13, but dem later come exhume am on September 21 for postmortem examination.

Many fans and celebrities for some states carry protest for road sake of di singer's death. Dem dey yan say dem wan make justice happen because dem suspect say e get more wey dey behind Mohbad's death wey eye no see.

Some people even dey call for di arrest of di music promoter wey dem sabi as Balogun Eletu, aka 'Sam Larry, and Naira Marley because of di wahala wey dem get with MohBad wey comot from Marlian Records with katakata. Sam Larry sef don enta police hand on top di matter. (NAN)

 

How u see di mata? #chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C